Templateiki Templates All Packed SEO /--> Mr Ibu reveal say im dey battle 'strange and dangerous sickness'

Mr Ibu reveal say im dey battle 'strange and dangerous sickness'

0

Mr Ibu reveal say im dey battle 'strange and dangerous sickness'




Nollywood actor and comedian John Okafor wey pipo sabi as Mr Ibu dey struggle wit im health.

For one video wey don spread on top social media di actor wey dey act comedy dey beg im fans to pray for am.

Di actor say im don dey hospital for sometime sake of one a "strange and dangerous illness”.

E say doctors don recommend make dem cut im legs.

“As I dey speak to you, I still dey lie down for hospital; di medical director of dis hospital say di best solution be say, in case im new idea no work, di best idea na to cut off my leg”, e tok for di sick bed wit im wife and daughter dia.

Mr Ibu further tok say make im fans tok to God as im no wan make dem cut im legs.

On Tuesday Mr Ibu celebrate im 62 years birthday for hospital wia e be like say e dey take treatment.

For di video wey im post ontop Instagram pesin fit notice how im leg and hands dey shake.

Family members dey beside am dey sing happy birthday song for am.

‘Please dis one time’



Mr Ibu daughter also enta social media beg for support for her papa.

Jasmine Okafor, bin beg make individuals or organizations help her papa for treatment abroad.

She say di family for dis point dey appeal make pipo come to her daddy aid and rescue, ‘for di past two weeks, daddy don dey very down, so we take am to hospital’.

“We bin don dey do everytin humanly possible; as family, we bin tink say na sometin we fit do on our own for am to dey fine, but e no dey get any better”.

E no dey get bette. Some days, e go be like say e don dey get better, some days, e go be like say e dey get worse, Jasmine tok.

"We dey for one of di best private medical facilities for Lagos, and deM wan refer us to anoda hospital sake of say e no get better here, she add.

No be di first time wey di actor sickness go enta public space be dis, for March 2022, Mr Ibu bin announce say e dey down wit food poisoning.

Born John Okafor, Mr Ibu na actor, stand-up comedian and MC from Enugu state, Southeast Nigeria.

E don act hundreds of Nollywood movies both for Nigeria and abroad.

Pipo sabi am for how im dey take keep im face wen e wan make pesin laff.

Post a Comment

0Comments
Post a Comment (0)